You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Hakainde Hichilema win Zambia presidential election for im second term
President Hakainde Hichilema don win di 2026 Zambia presidential election as e gada more dan 60 percent of di votes for di election.
Di Zambia Electoral Commission announce di final results from all di 226 constituencies, and e show say Hichilema and im party - di United Party for National Development - get a total of 2,965,326 votes, dat na 60.49 percent of di votes.
Di main challenger, Brian Mundubile of di National Reconciliation Party for Unity and Prosperity, get 1,856,217 votes or 37.87 percent of votes for di election.
Hichilema win by margin of more dan one million votes.
According to di numbers from di electoral commission, di total number of pipo wey dia names dey for di kontri voters register na 8,786,300, di valid votes wey pipo cast for di presidential election na 4,902,050, and di total number or ballots wey dey rejected na 126,566. Dis mean say di turn out for dis election na 57.23 percent.
Di oda candidates for di election no get up to 20,000 votes.
- Harry Kalaba of Citizens First party get 19,070 votes
- Kelvin Fube Bwalya of Zambia Must Prosper party get 17,078 votes
Dis victory mean say Hichilema go serve anoda term of five years until 2031.
Under Zambia electoral system, candidate must to get more dan 50 percent of di valid votes in order to win di presidential election for di first round, if not, a runoff election go take place.
For one statement afta di announcement of di election results, Hichilema tok say: "We dey truly humbled by di trust wey una don place for our hands."
E say di election show say Zambia na place of peace, law and order and na also "democratic nation wey dey settle our differences for di ballot box, and nowia else".
"To dose citizens wey prefer di ideas of our opponents, we hear una, and we go continue to work for una," e add.
Plenty of Hichilema supporters dress for di red colours of di United Party for National Development (UPND) and enta di streets of di capital, Lusaka, to celebrate afta di results declaration.
Dis result dey come afta ogbonge process wey get plenty gbas-gbos between di two major candidates.
Mundubile bin don claim victory for di election based on di independent calculation wey im campaign bin dey do by diasef, and e also accuse say di presidential election get plenty wuruwuru.
According to Mundubile, e get plenty difference between results from di polling stations and di one wey di electoral commission bin announce. E also claim say military personnel bin dey involved for di collation centres.
Di opposition chief also accuse Tanzania say dem bin send pipo to interfere for di election, although di Tanzania govment don reject di accusation.
E neva dey clear now weda di opposition go challenge dis election result for court.
On di day afta di election, di Electoral Commission of Zambia bin briefly suspend counting and announcement of results sake of reports say dia staff dey face violence and jaguda pipo wey dey snatch ballot papers for some areas. Dem late cancel di suspension on di same day.
However, regional and international election observers don describe di election day as largely peaceful for many of di polling stations wia dem bin monitor, and dem call on all di parties involved to remain calm and respect di official process.
Dem however raise concerns about late electoral reforms, media freedom and access to di media, during di preparation for di election.