Nigerian actors wey bin battle wit cancer as Ogogo family search for treatment

Published
Read am in 5 mins

Di health issue of ogbonge Nollywood actor Taiwo Hassan wey pipo sabi as Ogogo still dey cause tok-tok online and offline as Nigerians dey pray for am to defeat cancer.

Im daughters bin enta social media to announce say dia papa dey battle cancer and make Nigerians recommend wia e fit get treatment as hospitals don refuse to give am chemotherapy.

Dis dey come few months afta di death of Alexx Ekubo, anoda ogbonge actor wey pipo like well well.

Di tin be say cancer dey in different form, while some na prostate cancer, some na skin cancer, some na blood cancer and plenti oda types.

For dis tori, we put togeda few Nollywood actors and actresses wey die from cancer and dose wey fight am and still dey kampe.

  • Banky W

For May 2024, Nigerian singer Banky W wey im real name be Bankole Wellington announce say im successfully undergo im fourth cancer surgery.

For im Instagram page, Banky W share one long post wit title "Final Score - Christ 4 - Cancer Tumors 0".

Dat na di popular singer anoda successful surgery afta seven years. Na skin cancer Banky get dat time and e survive am and still dey alive till today.

Skin cancer dey shele wen skin cells dey damaged, for example, by overexposure to ultraviolet (UV) radiation from di sun, according to Cancer Council for Australia.

Banky W bin tank im wife Adesua wey also dey im side for di hospital for one video wey di singer release dat year.

  • Karibi Fubara

Dis Nollywood actor, Karibi Fubara die sake of cancer and im family members make di announcement on top social media page for 2021.

One of im sisters, Stella Fubara wey be di Director of International Operations for Dubai Tourism post for Instagram dat time say, "E be warrior, now e be angel for heaven."

Wednesday 15 December, 2021 na im Stella Fubara confam say di Nollywood actor die.

Di actor bin dey diagnosed wit cancer for 2020 and for im Instagram post afta di surgery, e say e bin receive di news say im get large mid-stage kidney tumor/cancer.

And on 3rd May, 2021, e say im do successful surgery to remove about 90% of di tumor.

Months later, e die sake of cancer.

  • Ify Onwuemene

Nollywood actress, Ify Onwuemene, wey bin dey popular for her role for di sitcom 'Everyday People', die of cancer for May 2021.

Na her colleague Gloria Anozie-Young, announce di news of her death for her Facebook page afta she battle wit endometrial cancer.

"Dem diagnose her wit endometrial cancer. Dem remove her womb, but she don dey battle wit di sickness for many years now." Na wetin she add put.

'For 2019, even afta eight sessions of chemotherapy, di doctors tell her say she don reach stage 4."

"But we no dey sure if dem bin give her wrong diagnosis or dem bin treat her wit di wrong chemo, becos she bin still dey feel pains for her upper abdomen and her tummy dey bloated."

For May 2021, Onwuemene die.

  • Alexx Ekubo

Alexx Ekubo die for May 2026 and many of im colleagues and fans pay tribute to di talented actor.

Later, family of di Nigerian actor reveal say di e die of metastatic kidney cancer.

Dem make di informate on di actor official Instagram page on Wednesday, 13 May, wia dem officially announce im passing.

"Afta brief but courageous battle, Alexx pass away for Evercare Hospital sake of complications wey arise from advanced metastatic kidney cancer," di family tok.

Wen cancer develop for di kidneys and spread to oda parts of di bodi, e dey known as metastatic kidney cancer - no mata wia di cancerous cells end up, according to Moffitt Cancer Center.

  • Sunday Akinola

Sunday Akinola na talented Yoruba actor, wey dey popular for im role as Ayo Mogaji for 'Feyikogbon', di TV series, but she also pass away for January, 2023.

Akinola death come come few months afta e mark 80th birthday.

Im death also come few years afta e reportedly endure long battle wit kidney failure - cancer of di kidney.

Tom Njemanze

Popular Nollywood actor, Tom Njemanze, bin fight for im life afta e dey diagnosed wit prostate cancer.

Im Nollywood colleagues try run around for funds to help am.

By July 2025, Tom Njemanze kpai afta e battle wit prostate cancer.

  • Sadiq Daba

Ogbonge actor and journalist Sadiq Daba first tell BBC say im no dey drink, smoke or chase women again afta God save am from prostate cancer and leukaemia.

Sadiq tell BBC News Pidgin say afta im hear say im get prostate cancer for di first time for im life, im go Redeem Camp for one week pray to God make e heal am and promise God say im go serve am for di rest of im life.

Sadiq bin join campaign enta streets for Abuja to create awareness about cancer and to raise money for poor Nigerians wey dey suffer from di disease.

Sadly for March 2021, Sadiq Daba die at di age of 69.

Di death of di Nigerian actor and broadcaster shock many pipo, as tributes enta for im pesin, work and legacy.