You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Tinubu appoint Abel Enitan as head of civil service of di federation
President Bola Tinubu don appoint Abel Olumuyiwa Enitan as di new Head of Civil Service of di Federation.
Enitan go take ova from Madam Didi Walson-Jack wey go soon retire from di Federal Civil Service as she don reach di statutory retirement age of 60.
One of di tok-tok pesin for di president, Bayo Onanuga wey announce di informate for inside one statement on Wednesday, 19 August, tok say di appointment go take effect from 27 August, 2026.
Di Nigerian leader urge Oga Enitan to lead civil service wey dey professional, merit-driven, accountale and wey dey responsive to di needs of Nigerians and aspiration.
E also charge am di incoming Head of di Civil Service of di Federation, "to consolidate on di reforms and innovations wey dey ongoing, deepen professionalism and efficiency across di service, and build a more effective and responsive Civil Service wey dey capable of delivering on di administration Renewed Hope Agenda."
Didi-Jackson retirement dey come afta she take responsibility for approving recruitment for di Presidential Economic Advisory Council/Presidential Foreign Intervention Promotion Council (PEAC/PFIPC), di agency wey di federal govment tok say na fake.
At di time, some Nigerians for social media say e no dey enuf for govment officials to just admit responsibility for dia negligence, dem suppose to either resign or make di President sack dem from office.
For one investigative hearing for di House of Representatives wey chook eye for di mata, Madam Walson-Jack bin admit say her office no try as dem fail to do di necessary background checks bifor dem give critical approvals to di 'fake agency'.
End of Di one wey oda users dey read well well
Tinubu appreciate Mrs Walson-Jack for her ogbonge service to di nation and for di reforms, impact and innovations wey di civil service bin witness during her tenure.
Abel Enitan profile:
Oga Abel Enitan na from Osun State, and na di most senior Permanent Secretary for di Federal Civil Service.
E don serve as Permanent Secretary for seven years and seven months, working for di Ministry of Police Affairs, di Ministry of Humanitarian Affairs, and Office of di Vice President.
Currently, e be di Permanent Secretary for di Federal Ministry of Education. E dey bring institutional experience and deep understanding of how di Federal Civil Service dey work to im new responsibility, according to di statement.
Dem born Enitan on 12 December 1966. E get im secondary education for Ajibode Grammar School, Ibadan and di College of Arts and Science, Ile-Ife.
E later attend di University of Lagos and graduate for 1988 wit B.Sc. in Finance and Banking.
For 2015, Enitan get im Masters degree for Public Policy Analysis from Nasarawa State University, Lafia.