83 more Nigerians dey expected to return from South Africa as 'mama of all protests' dey come

Published
Read am in 4 mins

Nigeria Ministry of Foreign Affairs don announce say 83 more Nigerians go land for Lagos on Wednesday wit di South African Airways.

For statement wey di ministry tok-tok pesin Kimiebi Imomotimi Ebienfa release say di returnees dey expected to enta di Murtala Mohammed International Airport for Lagos around 8:45pm for night.

Di new returnees dey come sake of private pipo wey decide to sponsor di plane tickets for di pipo to come back. Dis na according to di Ministry.

Di federal govment bin end dia voluntary repatriation programme wey bin see like 1,490 Nigerians comot South Africa enta back Nigeria on top Afrophobic attacks and anti-foreigner sentiments for di kontri.

Di ministry tok say, "In line wit im Citizen Diplomacy agenda, di govment no see Nigerians for di diaspora as burden but as ogbonge assets for national development and dey dedicated to ensure say dem dey protected and dey live well."

Di ministry also tank di pipo wey tanda to help wit dis humanitarian waka.

Dem tok say dia donation be beta example of di "whole of society approach" and di public-private collabo wey di govment dey ginger to take handle di wahala wey Nigerians abroad dey face.

Di ministry hail dia patriotism and selflessness say dia contributions don help calm di wahala of Nigerians for South Africa.

Dem kon ask make organised private sector, corporate joinbodis, state govments and well-meaning Nigerians for house and abroad make dem do wetin dis pipo don do say, "our collective efforts go ginger our national capacity to take ansa consular emergencies effectively".

Di govment tok say dem tanda gidigba to ginger strategic partnership wit host nations including South Africa. Dem dey run dis collabo to find wetin dey cause di koko of Afrophobia and make sure say acts of kasala and discrimination against Nigerians go dey prevented and dey strongly condemned.

Meanwhile, di March and March movement say dem go repeat di 30 June nationwide protest - dis time, di theme na for Africa kontri leaders to "fetch dia pipo".

Inside one statement, March and March say dem go gada outside di SADC summit auditorium during di event on Monday.

"We dey announce di second wave of di 30 June National Day of Action and call on di heads of state to prepare for massive deportation of all illegal foreigners for South Africa by 30 September wey go be di mama of all protest."

Dem add say, "South Africans gatz follow di law and remain di eyes and ears of di police against any illegal foreigners for di kontri."

Di 46th Ordinary SADC Summit of Heads of State and Government bin happun for di Inkosi Albert Luthuli International Convention Centre for Durban.

President Cyril Ramaphosa dey expected to become di SADC chairman for di 2026 and 2027 term.

Leaders for di 16 member states for SADC bin gada for di meeting - including kontris wey already evacuate dia citizens from di rainbow kontri during di tension.

Di Southern African Development Community (SADC) get kontris like Namibia, Mozambique, Mautritius, Zambia, Tanzania and Angola.

Di odas na Botswana, Malawi, Comoros, DR Congo, Eswatini, Madagascar, Seychelles, Zimbabwe, Lesotho and South Africa.