University suspend Nathan Cofnas wey accuse Jason Arday of plagiarism

    • Author, Maia Davies
  • Published
  • Read am in 4 mins

Di academic pesin wey accuse di late Cambridge professor Jason Arday say e commit plagiarism don chop suspension from im post for Belgian university.

Nathan Cofnas, wey be self-defined "race realist", dey among di pipo wey question Arday work and achievements - wey lead to one long plagiarism wahala wey last for weeks bifor im death on 14 August.

Cofnas say Ghent University dey investigate am "for discriminating against Arday".

Di university say dem bin don notify one staff member of "preliminary disciplinary investigation" and dem suspend am as warning.

For statement regarding Arday death, dia rector Petra De Sutter and vice-rector Herwig Reynaert tok say dem bin take "recent public statements wey postdoctoral researcher for Ghent University bin make regarding dis mata very seriously", and dem don take "appropriate action".

Dem say di university stand for "respect for human dignity and dem dey also oppose discrimination, hatred and racism".

"We attach great importance to academic freedom and to open academic debate, even wen views dey controversial. However, dat freedom no dey unlimited.

"E dey waka hand in hand wit responsibility and e fit dey restricted in order to protect di rights of odas."

Dem tok say di death of Arday supose "prompt reflection" and say pipo suppose learn lessons "regarding di way we treat one anoda both within and outside di academic world, particularly wen pipo becom di subject of public controversy".

Cofnas dey works as postdoctoral researcher for di university department of philosophy and moral sciences, according to im website.

Dem bin end im role for Cambridge college for 2024 afta him view say, under true meritocracy, black people go "disappear from almost all high-profile positions outside of sports and entertainment" wey make pipo drag am well -well wey also come wit backlash.

Cofnas bin claim say e put Arday work through plagiarism detection software wey find out say "e lift many passages wit minimal editing, sometimes e retain copy-editing mistakes from di original source".

Im also note say one retired professor bin previously raise concerns about Arday subsequent academic articles, wey bin make two journals to issuing correction notes.

Dem bin also ask quesions about Arday claims say im bin dey run 30 marathons in 35 days, and 300 miles in three days for charity, wey Arday say im bin use raise more dan £5m for charity, as well as running 600 miles ontop treadmill for six days.

Arday - wey becom Cambridge youngest black professor for 2023 - kpai fta dey find im deadibody for Battersea, south London, afta e resign as professor of sociology of education di week bifor.

Di 41-year-old bin face weeks of media coverage ova plagiarism allegations and questions about im achievements. im bin deny di claims.