Davido, Wike react to Adeleke Osun election victory, APC announce next move

Published
Read am in 5 mins

Afrobeat star, David Adeleke wey pipo sabi as Davido don drop plenty reactions afta im uncle election victory on 15 August.

Di Grammy award nominee tok say govment officials suppose understand say if dem work well for di pipo in dia community den di pipo go also support dem

Davido tok dis one during one interview for Ede in Osun state wia e dey address tori pipo afta im uncle Ademola Adeleke bin win di re-run for di Osun State gubernatorial seat.

E say dem win di election depsite di high number of politicians wey dey against dem from di opposition party.

Di musician thank di Osun residents for dia support and how dem protect dia votes during di election on 15 August.

"Na war, wen you get 17 govnors, 50 senators, house of representatives wey dey against one man and den im come out victorious, God dey good," Davido tok.

"To di Osun pipo wey no just vote for us, but stand dia ground, defend dia votes from polling units all di way to di local collation centre to di state collation centre."

"My uncle di governor suppose be example to all oda all oda govment officials out dia and govnors e show say if you work well for di pipo dem go work well for you. No matta wetin dem bring e no work becos di pipo dey wit us."

APC for no win Osun election if we apply federal might - Wike

Nyesom Wike, di Minister of Federal Capital Territory (FCT), tok say President Bola Tinubu no get any interest in di All Progressives Congress (APC) to win for Osun hinting say dem fit rig am for di rulling party to win di election.

"If di president really wan win di Osun state election at all cost, I go dey dia and we go win am, and nothing di governor fit do," Wike tok.

"We no use any federal might for Osun. Wen you see di force and might of di federal govment, you go know wetin I mean," e tok.

On Saturday, residents across Osun State head to di poll to vote for di next govnor of di state.

Ademola Adeleke wey dey re-run to become di govnor under di political party, Accord Party on 15 August, beat 14 oda contenders to emerge as winner for di elections.

Di Returning Officer Joshua Olalekan Ogunwole announce im victory for di keenly contested poll on Sunday morning.

Wit 511,067 votes, Adeleke defeat im closest challenger, Bola Oyebamiji of di All Progressives Congress wey poll 444,815 votes.

Inec declare Adeleke winner for 19 out of di 30 LGAs, while Oyebamiji, APC candidate, win di remaining 11 LGAs for di state.

Adeleke win di seat afta e bin hit one major fall few months earlier for im political career, wen di Peoples Democratic Party (PDP) wey e run as govnor for di first term scata sake of lack of coordination of leadership for di central level and factions wey break out within di PDP.

Adeleke enta di gubernatorial race through di Accord Party - one small party wey no dey too popular, and at di time, many pipo bin see am as risk and wonder how di small party go take face political parties wey don already get name and get big wig politicians.

However, Osun State residents bin rally around am to support di govnor as im make victory to reclaim di seat and di affection of di pipo in Osun State dey for display as many defended dia vote to ensure say Adeleke emerge as di govnor.

APC no gree say na Adeleke win di election- Osun state APC

Oluwole Oke, di director-general of di All Progressives Congress (APC) governorship campaign committee for di Osun election, believe say di Accord candidate no get di highest valid votes for di election wey happun on August 15.

Oke tok say di APC still dey study di outcome of di election, even thoughTinubu don congratulate Adeleke as di father of di nation.

"Mr. President, President Bola Tinubu, na di father of di nation. And as democrat, based on di announcement from INEC, e don drop statemen. E be father, im be leader, but we dey on di spot," Oke tok.

"We dey on ground and politics dey local. And like I tell you, wetin we dey do, even for di future, na to review di whole process well and form our opinion. We no go allow any kind pressure make we quickly congrats Senator Ademola Adeleke because we believe say he no get di highest valid votes."

E tok say Osun APC go study di numbers and do dia investigation. "We dey study di records. We dey check di records. And very soon, we go let di public know our position," e tok.