You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Australian tennis player Nick Kyrgios chop suspension afta e test positive for cocaine
- Author, Amy Lofthouse
- Role, BBC Sport senior journalist
- Published
- Read am in 4 mins
Nick Kyrgios don provisionally dey suspended from tennis afta e test positive for cocaine.
Di Australian bin submit sample during di Mallorca Open on 22 June wey dem later find to contain benzoylecgonine, wey be metabolite of cocaine.
Former world number 13 Kyrgios don dey provisionally suspended since 4 August.
Di International Tennis Integrity Agency say Kyrgios fit appeal against di provisional suspension "but neva do am till date".
Inside one post on Instagram, Kyrgios say e bin make "a huge mistake" and take "full responsibility" for am.
Under di suspension, Kyrgios no fit play, coach for or attend Grand Slams or any events sanctioned by di men and women tennis tours pending di outcome of a tribunal.
Di 31-year-old don play just four singles matches dis season, as e don struggle wit knee and wrist injuries in recent years.
E last play for di men doubles for Wimbledon, wia e and partner Alexander Bublik lose for di first round.
For one long statement wey e post for Instagram, Kyrgios tok say di injuries wey e don suffer for di last few years don “really affect am seriously, both mentally and physically”.
“My bodi no fit do wetin my mind dey expect am to do,” e write.
“To accept say I dey close to di end of my career don hard pass wetin I eva imagine.
“None of dis kain tins dey excuse wetin I do.”
Kyrgios tok say e go step away from social media and public life for di next 28 days to “focus on getting mysef right”.
Cocaine dey classified as stimulant and substance of abuse for World Anti-Doping Agency prohibited list.
Reduced sanctions dey apply to athletes wey test positive for di substance wen dem no dey compete.
However, dem collect Kyrgios sample for one tournament wey e play singles, and e lose for di first round to Adam Walton.
“I dey sorry to my fans, my family, my sponsors and evribodi wey dey close to me,” Kyrgios add.
“Above all, I dey sorry to di children wey dey follow me. I know di example wey dis one dey set and I dey deeply disappointed in mysef.”
E don tey wey Kyrgios be controversial figure for tennis.
Pipo don widely criticise im behaviour for court and dem don give am plenty big fines for smashing rackets, dey use bad words and argue wit di umpire.
For 2023, e admit say e assault one former girlfriend two years earlier. E avoid criminal conviction.
Pipo criticise am further for making series of comments wey dem consider women-hate words.
For 2024, e share one post from controversial influencer Andrew Tate. Later, e tok say e don go “to all lengths” to distance imsef from di self-proclaimed misogynist.
Kyrgios also criticise di way dem handle two high-profile anti-doping cases wey involve top players Jannik Sinner and Iga Swiatek, calling dem “disgusting” for tennis.
Kyrgios don win seven ATP Tour singles titles and reach di Wimbledon final for 2022, wia e lose for four sets to Novak Djokovic.
E and im compatriot Thanasi Kokkinakis win di Australian Open men doubles title togeda for 2022.
Kyrgios don also tok about im struggles wit mental health, say e “genuinely contemplate” to take im own life - e spend time for one psychiatric hospital for London afta e lose for Wimbledon for 2019.