Who be di Chawinga sisters wey carry Malawi reach Wafcon final

Published
Read am in 5 mins

Malawi Women football team , di Sorchers, surprise football fans as dem qualify for dia first ever Women Africa Cup of Nations final.

Na also di first time wey dem dey qualify and compete for di Women Africa Cup of Nations.

Dem don set and break record for dis tournament and na wit di help of two sisters wey dey di Malawi Women Football team.

For dia first match against Nigeria and 10-time champions, Temwa Chawinga bin score Malawi first and third goals, while her sister Tabita Chawinga score di second goal.

Nigeria manage score two goals bifor di match end 3-2 in favour of Malawi.

Di Chawinga sisters collabo again to score goal as dem beat Algeria 3-1 for di semi-final to reach dia first Wafcon final.

Malawi wey be first timers top Group C wit six points to progress of di group stage.

Dis na just one example of how Tabitha and Temwa Chawinga dey carry Malawi for dia back since dis Wafcon tournament start.

But who be Tabitha and Temwa Chawinga, wia dem dem play dia club football and who dem really be?

Temwa Chawinga

Temwa Chawinga na professional footballer and di di younger sister of Tabitha Chawinga.

Dem born on her on 20 September, 1998, for Rumphi district, wey dey for di northern region of Malawi, she be bi di last born out of five children wey her parents born.

Di 5.8 feet tall black footballer dey currently play for Kansas City Current for di National Women Soccer League (NWSL) wey be di top Women Football League for di United States of America.

According to Kansas City Current official website, Temwa Chawinga bin sign for di club ahead of di 2024 season.

She sign three-years contract extension on Jan. 29, 2025, wey go keep her for di club untill di 2029 season.

Temwa win di Golden Boot, award for di highest goalscorer for 2024 and 2025 wia she score 20 and 15 goals.

She also become di second player for di NWSL history to win di award multiple times.

Temwa dey hat as she also win di MVP for 2024 and 2025 as di first player for league laurels wey win di award back to back.

Chawinga also become di first player for di Kansas City Current club history to win di two awards.

For 2024, Chawinga become di first player for di league history to score 20 goals for one season.

She also record one goal in eight consecutive regular season matches and she score goal against all di 13 NWSL teams for di league.

Temwa na di fastest player to score 25 regular season goals for 34 games and she become di fastest player to score 30 regular season goals for 40 games.

Bifor she join Kansas City Current, Chawinga bin play for Wuhan Jianghan University F.C. for di Chinese Super League from 2020 to 2023.

She play 84 times and score 84 goals and also score 51 goals for di 2023 season alone wia she finish as di top scorer for di world across all competitions.

Chawinga bin also play for Kvarnsvedens IK, Sweden wia she score 55 goals in 57 matches.

For her international career, Temwa start to dey play for Malawi wen she dey 18 years.

Her first international goal na against Zambia for 2016 wen she captain Malawi National Team go di 2023, Council of Southern Africa Football Associations (Cosafa Cup).

She bin win di Golden Boot and Golden Ball wia she score nine goals.

Dem bin nominate her as CAF Women Player of di Year two times.

Dem bin also nominate her for Ballon d'Or for 2025 and finished No. 17 for di final rankings.

Tabitha Chawinga

Tabitha Chaŵinga na Malawian professional footballer wey dey play as forward for Première Ligue club Lyon and di Malawi national team.

Dem born her on 22 May 1996 for Rumphi District for northern Malawi.

Tabitha na di third born of five children wey her parents born.

Tori be say she start to play football wen she bin dey veri small and she bin dey play boys until she reach 13 years bifor she join DD Sunshine for Lilongwe, di capital city.

Tabitha Chaŵinga na di captain for Malawi Women football team.

Tabitha don play for clubs like Krokom/Dvärsätts IF, Kvarnsvedens IK in Sweden's Elitettan, Jiangsu Suning, Wuhan Jiangda, Inter Milan and Paris Saint Germain (loan).

Like her sister she dey score goals well-well and finish as top scorer for some of di leagues wey she play.