You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Canada extend visa processing time frame for Nigerian applicants
Canada through di Immigration Refugees and Citizenship Canada (IRCC), don extend di timeframe for visa applications processing for Nigerians and oda foreign nationals
IRCC extend di waiting period for temporary resident applications for Nigeria applicants from 68 days to 76 days. Di new processing time increase by one-week from di eight weeks wey im bin dey take to process di visas.
On 19 August, IRCC update dia temporary residence, study permit, work permit, visa application processing as di new changes go take effect on 26 August, 2026.
Di major changes na for super visa applications wey dem don increase di processing time frame for U.S applicants by two weeks and di timeframe for Pakistan visitor visa processing don drop.
Applicants from Pakistan work permit processing timeframe don fall from 12 weeks to seven weeks.
While di, visitor visa processing time increase from 61 days to 75 days.
Why di process time and service standard dey different
IRCC get two different measures wey dem use processing times and services. Processing times go make applicants know how long IRCC fit take to finalise new application for temporary residence, permanent residence, or citizenship.
Dis na just estimate and e no suppose be di deadline, guarantee, or maximum waiting period.
End of Di one wey oda users dey read well well
IRCC dey calculate processing times in two ways:
How long e take IRCC finalize 80% of applications wey dem don complete for dat kontri bifor.
How many applications dey wait for processing and di resources wey dey available to handle di applications.
Service standards na performance targets, no be estimates. Dis go show di timeframe wey IRCC dey aim to finalise some applications under normal conditions, mostly for 80% of cases.
Individual files fit take more or less time dan di number wey dem don estimate. Processing fit depend on how complex di application dey, di size of the inventory, operational capacity, request for additional evidence, and any oda check or assessment dey necessary.
Processing estimates fit change from one week to anoda. Short time frame no mean say dem go approve di application, while long time frame no mean say dem go refuse am.
Applicants go nedd check di official IRCC processing-time tool bifor dem plan dia travels, start dia new job or make final arrangements for schooling.
IRCC dey update temporary residence processing weekly, while dem dey update permanent residence and citizenship dem monthly.
IRCC report say dem process 1,566,455 temporary residence applications for di first six months of 2026. Ova 401,000 applications still dey pending by di end of June.
Work Permits
Canada go begin process Pakistan visa faster as dem dom reduce di time frame by five weeks.
Application from:
Canada 117 days
India 9 weeks
Pakistan 7 weeks
Nigeria 9 weeks
United States 2 weeks
Philippines 6 weeks
Pipo wey dey within Canada na 120 days for submission and 60 days outside Canada.
Study Permits
IRCC don increase di timeframe dem go begin prosss Nigeria visa, dem don increase di waiting time bu one-week.
Application from:
Canada 7 weeks
India 5 weeks
Pakistan 7 weeks
Nigeria 9 weeks
United States 5 weeks
Philippines 4 weeks
Pipo wey dey within Canada na 120 days for submission and 60 days outside Canada.
Visitor Visas
Canada go reduce di time frame for visitor visa.
Application from:
Canada 12 days
India 31 days
Pakistan 75 days
Nigeria 76 days
United States 21 days
Philippines 21 days
Na 14 days submission for pipo outside Canada.
Super Visas
IRCC don increase di Super visa wait times across all kontris, dem increase di timeframe for U.S by two weeks and reduce di timeframe for Pakistan.
Application from:
India 56 days
Pakistan 176 days
Nigeria 53 days
United States 138 days
Philippines 107 days
Na 112 days submission for pipo wey dey Canada.