Wetin we know as two security men wey allegedly sexually abuse autistic student for Ghana enta police net

Published
Read am in 4 mins

Education authorities for Ghana don condemn di alleged sexual abuse of one young girl for di Bolgatanga Girls' Senior High school (Bogiss).

Tori be say two security men for di school campus bin sexually abuse di minor – special needs pickin - many times.

Inside one statement, di Ministry of Education confam say di victim be student wit autism for di school.

"We condemn any act of sexual abuse or exploitation of children under our care. Schools dey to protect and train students, we neva go tolerate di situation wia adults wey gatz protect dis children, go dey abuse dem."

Di ministry tok say "we dey confam say pesin wey be minor no fit dey responsible for sexual abuse against her by adults."

Dis matter don cause serious tok tok as di two men don inside police net say of di accusation.

Wetin we sabi so far about di sexual abuse allegation

According to di Ghana Education Service (GES), di two accused pipo be watchmen for di Bolgatanga Girls' Senior High School (Bogiss).

"Di student be special needs pesin wey dey on medication," tok-tok pesin for di Education service Daniel Fenyi explain.

Inside di GES letter, dem add say "on di day of di incident, di student bin suffer relapse wia she bin dey need medical attention; na for dis time wey di alleged sexual abuse don happun."

Some pipo tok say di sexual abuse on di autistic student bin happun multiple times; sometimes for di dining hall or for di security booth for di school gate.

Di Ghana Education service bin cause di arrest of di two suspects – wey dem carry dem give di police for further investigation.

"In addition to di arrest, management don interdict dem wit immediate effect. Investigation dey continue for di mata wey management go apply appropriate punishment according to di Ghana Education Service code of conduct and di laws for di kontri,"

Di GES don warn staff of schools say make dem uphold di "highest standard of professionalism and protect di dignity, safety and wellbeing of every student."

Wetin Ghana authorities tok

Di minister for Education Haruna Iddrisu don order di kontris Education Service to:

  • Investigate di mata and report to di ministry immediately
  • Ensure say di victim receive all di necessary medical care and counselling make she recover fast
  • Immediately restore di victim im boarding school status afta school authorities bin sack her for di boarding house

Di ministry statement wia di deputy minister Dr Clement Apaak don sign add say "we want assure di family of di victim and di public say di ministry go ensure justice for dis mata."

Bifor di Education ministry chook mouth for dis mata, di Ghana Education Service (GES) wey don dey regulate schools for Ghana, begin investigation for dis case.

School authorities bin first sack di victim from boarding house

Pipo don para afta one letter from di Bogiss school authorities wey sack di victim from di boarding house.

Di letter wia headmistress of di school – Gifty Ayamba don sign, na recommendation from one disciplinary committee wey chook mouth for di case of di autistic student.

Authorities for dat letter to parents of di victim, tok say "di school bin take di decision to remove your student from di boarding house and make her day student wit immediate effect."

"According to di GES code of conduct, your daughter dey guilty of sexual misconduct, na so we bin dey sack her. However, sake of she get special needs, di school don recommend say make she be day student for one year," di letter to di parents of di girl add.

Di school also add say "her parents gatz take her for medical attention and give di report to di school."

Afta dis letter enta social media, pipo don vex wey dem call out di school authorities for dis decision.

One Ghanaian politician and diplomat Tangoba Abayage condemn di school authorities.

"I hope authorities go handle dis mata well and ensure say di pipo wey abuse di girl go face justice. I also hope say di Ghana Education service go call di headmistress to order."

One journalist Doreen Ampofo tok say "how we reach dis point? Why di school bin dey punish di victim, instead say dem go take responsibility?"

"Dem gatz sack dis headmistress wey issue dis letter to di parents of di victim."

Education tink tank Africa Education Watch don tok say dia investigation show say di minor begin to suffer di alleged sexual abuse from di beginning of June dis year, wia e continue till July.