Osun governorship election live updates: Inec declare Adeleke winner of Osun govnorship race

Dis na BBC News Pidgin coverage of di 2026 governorship election for Osun state.

Summary

Live Coverage

Victor Ezeama and Tunde Ososanya

  1. 'Let di will of di pipo prevail' - Govnor Ademola Adeleke

    Govnor Ademola Adeleke

    Osun State Govnor Ademola Adeleke don call on di Independent National Electoral Commission (Inec) to uphold di highest standards of integrity for di ongoing state govnorship election.

    Di govnor give dis informate on X as electoral officials begin sort and count votes for polling units across di state. E say make di “will of di pipo prevail”.

    E hail di security agencies wey dey deployed for di election and urge dem to remain vigilant as di electoral process move into collation of results; from polling units to wards to local govment areas.

    Adeleke also express confidence for all di institutions wey dey involved for di election as e say di federal govment don try well-well wit security.

    Democracy dey at im strongest wen we honour di wishes of our pipo and protect di sanctity of dia votes.

    “To evri Osun citizen: I urge you to remain peaceful, law-abiding, and committed to dis democratic moment,” Adeleke add.

  2. Govnor Adeleke Accord party win polling unit

    Osun govnor Ademola Adeleke
    Result sheet

    Govnor Ademola Adeleke of Accord party don win im own polling unit.

    Adeleke defeat im rival Bola Oyebamiji of APC wit 421 votes. APC get 29 votes.

    Adeleke dey among di first voters for im Polling Unit 009 Abogunde compound, Ward 02 Sagba, Ede North.

    Govnor Adeleke dey seek re-election for second term under di Accord Party.

  3. Inec don begin upload election results on IREV

    IREV portal for Osun state govnorship election

    Di Independent National Electoral Commission (Inec) don begin upload results from di ongoing Osun State govnorship election for dia Result Viewing Portal (IREV).

    Di kontri electoral bodi begin upload di results shortly afta voting end for several polling units across di state.

    Inec bin fix 2:30pm as di closing time for voting for di election.

    As of di time wey BBC News Pidgin file dis report, dem don upload 663 polling units results to di IReV portal out of 3,763, wey represent 17.62% of di total results expected.

    Dis development show di commencement of di electronic transmission and public viewing of polling unit results as officials proceed wit di collation of results from di election.

    Di IReV portal dey allow members of di public plus oda stakeholders to view results dem upload from polling units. E dey provide more transparency for di electoral process.

  4. Govnor Ademola Adeleke condemn alleged arrest of Osun PDP chairman

    Governor Ademola Adeleke addressing an audience

    Di govnor of Osun State and candidate of di Accord Party for di ongoing election don condemn di alleged arrest of state Peoples Democratic Party chairman, Sunday Bisi.

    Di govnor say security pipo gbab Sunday Bisi for im house afta e cast im vote.

    “Information wey reach me indicates say Hon. Bisi bin dey accosted for im home for Ilesa shortly afta e returned afta voting, and dem take am away to location wey neva dey known,” e tok for statement.

    E say di security pipo no tell anyone di reason for im arrest.

  5. Sorting and counting of votes don start for some polling units

    Electoral officer hold material

    Sorting and counting of votes don start for some polling units for Osun State as di govnorship election still dey go on.

    Electoral officials don begin count votes for Unit 1, Ward 1, Itakogun/Egbe-Idi, Ilesa West LGA, Osun East Senatorial District.

    Counting of ballot papers don also start for Polling Unit 007, Ward 02, Ede North.

    Meanwhile, confusion dey for Polling Unit 007, Ward 02, Ede North ova void votes on ballot paper.

    Di Coordinating DIG for di Osun State Govnorship Election Isyaku Mohammed, during one aerial surveillance and real-time monitoring of security deployments across di state tok say di police tanda gidigba to protect lives and secure di electoral process.

    Wetin we call dis Video, Osun governorship election: Vote counting dey go on afta polls close
  6. Former Osun state govnor Adegboyega Oyetola don cast im vote

    Forer Osun govnor Adegboyega Oyetola cast im vote

    Former govnor of Osun State Adegboyega Oyetola don cast im vote for di Ward 1, Unit 10, Iragbiji, for di ongoing election.

    Oyetola wey also be di Minister of Marine and Blue Economy tok say di voting exercise dey peaceful across di state.

    E advise evrione to remain peaceful and allow di will of di pipo to prevail. Oyetola also tok say pipo turn out well-well for di exercise.

    Oyetola also hail di security personnel for dia professionalism and dedication to maintain peace throughout di exercise.

  7. Party agents for one polling unit unite for peace

    Party agents gada togeda to show say dem dey peaceful during di election process.

    At least dem unite to show say kasala no dey for dia side, evriwia dey okay.

    Party agents including one woman stand for group foto
    Wetin we call dis foto, Party agents gada to show say kasala no dey for dia unit.
  8. Lines for some polling units dey empty but pipo wey don vote dey wait for counting

    For some areas, voters no too show face like dat.

    BBC News Pidgin tori pesin wey dey cova di election say for polling unit 001 Baptist Day Primary School, Ward 09 Ojo/Aro Egbedore LGA, out of ova 700 registered voters na only 300 pipo don vote so far.

    E send dis tori around few minutes past 1pm for afternoon.

    Di line dey empty. Plenti pipo neva come out to come vote, while dose wey don vote still hang around to wait for counting of votes.

    Three Inec officals siddon for bench wit one pesin wey be like voter stand for dia front
    Wetin we call dis foto, Foto of polling unit 001 Baptist Day Primary school Ward 09 Ojo/Aro Egbedore LGA
  9. Osun election 2026: Young pipo still come out to vote, Even though some polling unit dey almost empty odas get plenti pipo

    Inec official siddon for chair while voters dey stand for line.
    Wetin we call dis foto, Inec oficials wit voters wey stand for line dey wait to vote

    Young pipo come out to cast dia vote for di Osun State govnorship election.

    While some polling unit dey almost empty, Polling unit 10 Ejigbo get crowd.

    Voting process dey go on as men and women queue for different lines to cast dia votes.

    Some.young voters also dey queue as dem dey enjoy di peaceful process.

    Voters arrange diasef for two lines ad dem dey wait peacefully to vote
    Wetin we call dis foto, Voters arrange diasef for two lines ad dem dey wait peacefully to vote
    Close-up foto of young pipo wey stand for line to vote
    Wetin we call dis foto, Close-up foto of young pipo wey stand for line to vote
  10. ADC candidate comot from wia dem destroy im polling unit, Tori be say pipo bin no know wia im dey wen di kasala happun

    ADC candidate, Najeem Salam
    Wetin we call dis foto, ADC candidate, Najeem Salam

    Tori pipo don confam say di candidate of di African Democratic Congress (ADC) safely comot for di area wey kasala bin happun.

    Tori be say e escape through anoda route.

    Kasala bin burst for di African Democratic Congress (ADC) candidate polling unit.

    BBC News Pidgin tori pesin wey dey on ground wen e happun tok say some guys come di polling unit wia dem break all di ballot box.

    According to him police showface for di polling unit to intervene for di mata.

  11. Fotos of destruction wey happun for ADC candidate polling unit

    Ballot box dey for ground wit electoral materials inside wit police pipo leg near am
    Wetin we call dis foto, Foto of ballot box wey don break wey dey for ground.

    Dis na fotos of di destruction wey happun almost immediately afta di African Democratic Congress (ADC) govnorship Candidate Najeem Salam cast im vote for Polling unit 13 Ward 04 Ejigbo LGA

    BBC News Pidgin tori pesin wey bin dey on ground wen e happun tok say some guys come di polling unit and dem break all di ballot box.

    According to him police showface for di polling unit to intervene for di mata.

    Nigeria secret police di DSS don arrest di man.

    Part of di side window glass break, e be like say stong object hit am.
    Wetin we call dis foto, Foto of bus window glass wey break
    Blue canopy wey be like wetin fall by force dey for ground
    Wetin we call dis foto, Canopy wey bin stand dey for ground
    Woman wey dey hold di collapsed voting boot be like say dey dey put am back inside bag
    Wetin we call dis foto, Pesin wey look like electoral official dey pack di polling unit voting boot
  12. Moment wey thugs scata polling unit wia ADC candidate vote

    We don confam say candidate of di ADC Najeem Salam don comot for di area wey violence happun.

    E escape through anoda route.

    Wetin we call dis Video, Osun govnorship election: Live from ADC Candidate polling unit wia thugs scatta election,
  13. Breaking, APC candidate Bola Oyebamiji cast im vote

    All Progressives Congress (APC) candidate, Bola Oyebamiji wear white cloth wit dark navy blue and pink stripe design cap
    Wetin we call dis foto, Di All Progressives Congress (APC) candidate, Bola Oyebamiji cast im vote for polling unit 11, ward 9 Gantry Are for Ikire, Irewole LGA

    Bola Oyebamiji, govnorship candidate of All Progressives Congress (APC) don cast im vote for im polling unit, for Irewole for Osun State on Saturday.

    Di candidate arrive for im polling unit 11, ward 9, Gantry Are for Ikire, Irewole LGA wit im wife and party faithfuls to vote dis morning.

    Na 15 candidates dey contest for di election, including di top contenders, Ademola Adeleke of Accord Party and Bola Oyebamiji of All Progressive Party.

    Osun get 2,339,233 registered voters, but na only 1,906,390 of dem, wey be 81.50%, don collect dia Permanent Voter Cards (PVCs) wey dey eligible to participate for di Saturday poll.

    Skip YouTube post
    Allow Google YouTube content?

    Dis article contain content wey Google YouTube provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Google YouTube cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites. YouTube content fit contain adverts.

    End of YouTube post

  14. About 100 pipo dey police custody for di last one month - Osun State Commissioner of Police tok

    Osun State Commissioner of Police wey dey in charge of di 2026 election, Mr Erale Samuel Etaif say dem don arrest about 100 pipo.

    Im add say di pipo wey dey dia custody come from neighbouring states of Ondo and Ekiti to scata di election for di past one month.

    Howeva, im clarify say dem neva arrest anybody becos of electoral violence today (election day)

    Skip X post
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post

  15. DSS arrest man wey cause kasala for ADC candidate polling unit

    Di man wear purple cloth, e kneel down for ground and e hold money(cash) and and green bottle  for hand
    Wetin we call dis foto, DSS catch pesin wey cause kasala for ADC candidate, Najeem Salam polling unit.

    Kasala burst for di African Democratic Congress (ADC) candidate polling unit.

    BBC News Pidgin tori pesin wey dey on ground wen e happun tok say some guys come di polling unit wia dem break all di ballot box.

    According to him police showface for di polling unit to intervene for di mata.

    "We no know wia di ADC candidate dey currently...some guys don scata dis polling unit" im tok

    Latest tori be say Nigeria secret police di DSS don arrest di man.

  16. Husband carry im wife wey no fit waka to go vote

    Elderly man and woman dey ontop okada, di man dey ride di okada whuile di woman sidon for back as she hold her stick
    Wetin we call dis foto, Husband carry im wife wey no fit waka ontop im okada make dem go vote.

    Elderly husband and wife come to vote.

    Even though di mama no fit waka, she still try come out to vote for Polling unit 13 Ward 04 Ejigbo LGA

  17. Osun state govnor Ademola Adeleke call for free and fair election

    Adeleke Ademola for Osun
    Wetin we call dis foto, Foto of Ademola Adeleke

    Govnor of Osun State, Ademola Adeleke don call on di Inspector General of Police, Olatunji Disu say dem want only free and fair elections for di Osun state election.

    Di Accord Party gubernatorial candidate tok dis on Saturday morning afta im cast im vote for ward 2, Ede North, Osun State as im dey run for im second term in office.

    Adeleke tok say dem no want any kasala for Osun State during dis govnorship election.

    Adeleke tok say make police no just move di ballot paper go di state capital as e suppose go ward, local govment bifor e go reach di capital.

    "I don tell di inspector general of police say we no want violence. Na free and fair election we want," Adeleke tok.

  18. Breaking, ADC govnorship candidate Najeem Salam don vote

    African Democratic Congress (ADC) govnorship Candidate Najeem Salam don cast im vote for Polling unit 13 Ward 04 Ejigbo LGA

    Inec official put Bvas for ADC govnorship candidate, Najeem Salam face
    Wetin we call dis foto, Inec official dey accredit di ADC govnorship candidate, Najeem Salam wit Bvas for im polling unit.
    Najeem Salam wear all white cloth wit black cap, oda pipo stand near am
    Wetin we call dis foto, ADC govnorship candidate, Najeem Salam for im polling unitg
  19. Allegations of vote buying dominate Osun election

    Vote buying allegations

    Tori of alleged vote buying dey happun for some polling units for di Osun State govnorship election.

    Polling Unit 13 Iroyin Ayo Open Space Ward 04 Ejigbo LGA

    around 10:17am dem see case of vote buying and vote selling.

    Dem catch some party members wey dey carry cash dey try buy pipo vote.

    Di voters catch dem and collect di money from dem.

  20. Bola Tinubu tell Inec to avoid mago-mago, Many threats and alleged tori of attack bin dey fly upandan during di build-up to di election

    Nigeria President, Bola Tinubu
    Wetin we call dis foto, Nigeria President, Bola Tinubu

    President Tinubu tell Inec, security pipo to make sure say magomago no dey for Osun govnorship election and make dem dey peaceful, transparent, and credible.

    Oga Tinubu tok for statement on Friday wey im Special Adviser on Information and Strategy, Bayo Onanuga post ahead of di election on Saturday, 15 August, 2026.

    “As di pipo of Osun State dey go dia polling units to elect vote who go govern dem for di next four years, I call on di Independent National Electoral Commission to ensure orderly conduct of di election.

    Di election must dey transparent, free and fair. I urge Inec to ensure di integrity of di process”