Trump, Putin and Xi release 'peace declaration' afta historic meeting

    • Author, Harriet Whitehead
  • Published
  • Read am in 4 mins

US President Donald Trump, Russian President Vladimir Putin and Chinese President Xi Jinping don issue one "joint declaration of peace" afta one historic meeting between di leaders.

Di three world leaders bin meet on di sidelines of di Asia-Pacific Economic Cooperation (APEC) summit, for Kylin Villa in Shenzhen for one hour and 20 minute long discussion on Thursday.

While the presidents don previously meet for one-on-one meetings, dis na dia first trilateral discussion.

Afta di meeting, di group make one "declaration of peace", wey state say "nuclear war no fit get winner and e must neva happun".

Dem also announce plans to increase di production and supply of petroleum, as part of efforts to strengthen energy security and economic stability across di world.

Di statement also touch on di issue of immunity wey govment officials dey enjoy, and di three leaders agree say International Criminal Court (ICC) and oda similar institutions no suppose misuse or overstep dia powers.

While Trump dey for China, e first meet wit Vladimir Putin bifor di trilateral discussion. Na dia first meeting since August 2025, and di US president greet di Russian leader as im "friend".

E also hold separate talks wit Xi Jinping, as e describe di two of dem relationship as "very special".

Beyond di warmth and shared niceties howeva, di three men bin get very different goals and motivations for di sit-down.

Key points from di historic meeting

Di opening remarks of di trilateral bin give some indication about wetin dem wan discuss during di closed-door meeting.

Bifor e give floor to im fellow leaders, Xi tok say "positive interaction among major powers no be mata of choice, but compulsory requirement".

Putin come tok say one of di main things wey unite dem na dia interest to end di war for Ukraine. E add say dia discussion go also cover important issues like food security and energy security.

China govment for Xi Jinping don longtime maintain say dem dey neutral for di Ukraine war. Beijing don repeatedly call for peace talks, negotiation and political solution to di conflict, while avoiding direct condemnation of Russia ova di full-scale invasion.

As di meeting end, Trump say leaders of di three biggest countries for di world get "special responsibility" to keep communication channels open and productive.

"Too often, past leaders don avoid talking to countries wey dem get disagreements wit," Trump tok. "We feel di opposite."

Trump touch on di three countries' nuclear capabilities and say dem dey "uniquely positioned to discuss how to reduce di number of nuclear weapons on Earth".

E dey "vital" say dem cooperate to "combat di threat of nuclear proliferation in oda countries around di world", e tok, as e add say: "Dat na wetin we dey do for Iran."

"We no go let Iran get nuclear weapon".

Trump den turn to Ukraine and say im and Putin don get "long discussion" on di conflict there already.

E add say Putin "and I hope di oda side, go like to see an end to dat war".

Putin address di media afta di trilateral meeting and e describe am as an "important chapter for di history of diplomacy".

E say Kyiv and Europe neva ready to make compromises to resolve di conflict for Ukraine.

Putin also respond to people wey dey compare di meeting with Trump and Xi Jinping to di famous 1945 Yalta Conference, where leaders of di Soviet Union, Britain and United States met towards di end of World War Two.

"Nobody divide di world for Yalta Conference. Na simply to recognise and formalise di realities wey emerge afta World War Two," Putin tok.

"And as e concern today conflicts, evribody go need accept di realities wey dey on ground."

Di Kremlin release one video wey show as Putin dey comot di summit venue and e say goodbye to Xi.

"Thank you for organising dis," Putin say. "I no tink say anyone bin even dey expect evritin to go so well."

Meanwhile, China president bin describe im meeting wit Putin and Trump as "positive, constructive, and highly productive", according to di kontri state broadcaster CCTV.

Dem add say Xi recall "di history of fighting side-by-side during WW2", as di three leaders emphasise di importance of "cherishing di hard-won peace".

According to report, Thursday trilateral meeting na Putin idea.

Some Russian newspapers call am "diplomatic victory" as afta Russia full-scale invasion of Ukraine for 2022, many Western leaders bin dey try to isolate am.

Di summit also mark di first time since Russia war for Ukraine start wey Putin take part for one international gathering wey leaders from countries including Canada, Japan and Australia attend.