You dey view text-only version of dis website wey dey use small data. Check di main version of di website wey get all images and videos.
How state police go look like for Nigeria if Tinubu sign am into law
Di Nigerian Senate don move for di passage of di Constitution of di Federal Republic of Nigeria (Sixth Alteration) Bill, 2026, wey go establish State Police.
Senate say dem don ready di bill for transmission to di President for assent.
Di Senate resolve say dem go mandate di Clerk to di National Assembly to transmit "'A Bill for an Act to Alter the Constitution of the Federal Republic of Nigeria 1999, to Provide for the Establishment of State Police Services, and for Related Matters (Sixth Alteration) 2026,' to di President, Commander-in-Chief of the Armed Forces of di Federation, for im assent, in line wit Acts Authentication Act, 2004."
Di state police bill don now make considerable progress for di Senate.
Di move dey come as security wahala kontinu across Nigeria, wey include banditry, mass kidnappings and communal violence, wey federal security agencies don struggle to contain.
Pipo bin raise concerns about shortage of police officers, wey sabi pipo say lack proper equipment, adequate training and dey vulnerable to corruption for di kontri wey get more dan 200 million pipo.
How we reach hia for di State police bill
Di Senate and di House of Representatives begin process of support for di bill on 24 June and 23 July, 2026, wen ova two-thirds majority vote for di bill.
Di two-thirds majority from di National Assembly mean say dem don meet di constitutional threshold for di passage of di bill.
Afta dat, di Nigerian National Assembly transmit di Bill to di 36 State Houses of Assembly for di mandatory approval.
Dat stage require make 'not less than two-thirds majority of di State Houses of Assembly' fit agree to di bill according to section 9(2) of di Constitution bifro dem go pass am.
For November 2026, Senate give six State Houses of Assembly some days to finalise dia resolutions of di creation of State police bill.
Dis na afta di Senate Leader, Senator Opeyemi Bamidele, mention say 30 State Houses of Assembly don approve di proposed constitutional amendment to establish State Police.
Although, Senator Bamidele explain say di number of approvals don pass di constitutionally required two-thirds majority of 24 states, wey represent di threshold wey dem need for di passage of di bill.
Wen 15 November, 2026, reach wey di Senate give di State House of Assembly, di whole 36 states give dia positions.
Na dis one come pave di way for di transmission of di bill to di President for assent.
Some kontris wey dey practice state police compared to Nigeria
US: For United States of America, policing dey decentralized, wit state and federal agencies wey dey operate under separate legal authorities instead of one single national police force.
State govments get general "police power" to protect public safety and enforce state laws, while federal agencies enforce specific federal laws across di kontri.
Evri U.S. state get one state policing agency, wey dem often call state police force or highway patrol. Dem dey enforce state criminal and traffic laws.
Australia: For Australia, each state and territory get im own police force, such as di New South Wales Police Force, wey dey handle evriday crime and traffic laws.
Di Australian Federal Police (AFP) dey enforce federal laws, handle counterterrorism, and provide local policing for di Australian Capital Territory.
Canada: For Canada, policing dey shared among federal, provincial and municipal levels.
Ontario and Quebec get dia own provincial police forces, while di federal Royal Canadian Mounted Police (RCMP) dey enforce federal laws nationwide and also serve as provincial and local police for most oda provinces.
If Nigeria sign dia own bill into law, e mean say dem go join oda countries wey dey operate dat kain system.
Wat next if President Tinubu sign or no sign di bill
Now wey di Senate don transmit di State Police to di Oga Tinubu for Presidential assent, kwesion dey as to wetin go happun next.
According to di rules wey guide how bill dey become law for Nigeria, e stipulate di number of days wey di bill go stay to allow di president give im assent.
Di rule stipulate say within 30 days, di president gatz sign di bill or withhold im assent.
"If signed, e go become an Act of di National Assembly. If vetoed, bill return wit reasons. If president fail to act within 30 days (and legislature dey in session), bill automatically becomes law."
Once di president sign di bill, e go become. Meanwhile, in di event wey di president no gree sign di bill, di law say two-thirds of di National Assembly fit override am.
"Each chamber fit override veto by two-thirds majority. Both chambers reconsider di bill. If at least two-thirds of members for each house vote to override, di veto dey overturned and bill become law without presidential signature."
Afta di override or presidential assent, di bill go become law and dem go publish am as 'Act of Parliament'.
Dem go publish am for di govment Gazzette and e go take effect on di date wey dem specify for di Act.
Provisions of di state police and state dey ready?
Di bill bifor di National Assembly get aim to strengthen security command for Nigeria by decentralizing di police.
Dem wan change sections 197, 214, and 215 of di 1999 Constitution, wey go further redefine di powers, management, and control of di Nigeria Police Force.
If President sign am, di bill go lift di exclusive police control from di president and di Inspector-General of Police to allow for di creation of State Police, and grant state govments clear control ova security agencies under dia control, particularly di police.
Di proposal for di bill make provision for di establishment of both federal police and State Police, and to clearly forbid di Federal Police make dem no interfere wit di operations of di State police, wen dem create am.
For di same development, Clause 13 of di bill wan look into di appointment of di Inspector General of Police and Commissioner of Police of State by granting di legislature – both federal and state, di authority to approve dose appointments.
In terms of funding, di establishment of State Police alteration bill 2023, also point to sources of funding wey go dey available for di police, as e empower di Federal govment to provide aids for State police wit di approval of di National Assembly.
If e pass through wit Presidential assent, e mean say state go get more control ova dia own policing.