South-African human rights lawyer Navi Pillay win 2026 Nobel peace prize

Navi Pillay
Published
Read am in 5 mins

Former UN human rights chief and International Court of Justice judge, Navi Pillay don win di 2026 Nobel Peace Prize.

Dem recognise di South African judge "for her effort to promote peace and international law" wey don make way for "good global legal order," di Nobel committee tok.

Navi Pillay, wey be 85 years old, don spend many decades dey investigate allegations of human rights violations for different parts of di world. She don play key role for major inquiries wey involve abuses for Rwanda, Myanmar and Gaza, as part of her long career fighting for justice and human rights.

Her early work include defending anti-apartheid activists for South Africa, and on Friday, she bicom di kontri fifth Peace Prize winner - she follow for di footsteps of Nelson Mandela and Archbishop Desmond Tutu.

Chairman of di Norwegian Nobel Committee, Jørgen Watne Frydnes tok say, work wey Navi Pillay don do dey "instrumental in ensuring say war crimes, crimes against humanity, and genocide face prosecution."

"Navi Pillay dey commitment to universal legal principles and her strong moral compass don remain constant throughout her long and distinguished career," e tok

"At di time of existential challenges - including more wars and conflicts dan di world don see for long time - international law no be just supplement to peace and security. Na absolute necessity."

Frydnes tok say di committee neva notify Pillay say she don win bifor now, "so my message to her go be 'if you see Norwegian number wey dey call you, abeg pick am'".

Later, Pillay react to di news say "e fit be joke", and she thank pipo wey gada to clap for am.

"If you clap more, I fit share dis prize wit Trump," she tok. Last year winner, Venezuelan opposition leader María Corina Machado, give her medal to di US president for January as "recognition for im unique commitment to our freedom".

Pillay chair di report wey accuse Israel of war crimes

Northern Gaza City on 07 August 2026

Di commission conclude say Israel bin commit genocidal act for Gaza, and di Isreali Prime Minister Benjamin Netanyahu, and im former defence minister Yoav Gallant, don "incite di commission of genocide" for dia speeches and statements.

Di three-member expert panel no speak officially for di UN and dem no get legal authority. Israel reject dia findings and accuse di three members of di commission say dem dey serve as "Hamas proxies".

Di panel bin conclude say Hamas and oda Palestinian armed groups commit war crimes and oda serious violations of international law on 7 October 2023, wia about 1,200 pipo die and dey hold anoda 251 hostage. Di same report also accuse Israel of war crimes.

Reacting to Pillay award on Friday, Israel Foreign Ministry tok say na "grotesque weaponisation of an award to legitimise anti-Israel hatred and prejudice".

Inside di state e tok say: "Her role for di relentless, politically motivated demonisation of Israel and promotion of di genoLIE speak volumes."

Wetin be di reaction of world leaders?

Foto of Spanish Prime Minister Pedro Sanchez, Navi Pillay and Cyril Ramaphosa

South Africa President Cyril Ramaphosa tok say she be "pioneering defence attorney wey dey defend anti-apartheid activists" wey don work to "uphold human dignity and bring hope for South Africa and for pipo globally."

Spanish Prime Minister Pedro Sanchez congratulate Pillay for her win, e tok say she "devote her life to... defending di weak against di powerful."

UN human rights boss Volker Turk tok say Pillay recognition na "reaffirmation say human rights, rule of law and justice, and accountability dey fundamental for everytin, for peace, security, and prosperity."

Amnesty International Secretary-General Agnès Callamard tok say she dey wit Pillay wen she hear say she don win - and call her "inspired choice" for di award.

Who be former human rights commissioner Navi Pillay?

South African lawyer Navi Pillay (L) arrive for di press conference at di International Nuremberg Principles Academy for Nuremberg, Germany.

Navanethem "Navi" Pillay grow up for South Africa during apartheid as bus driver pikin for one poor Indian area for Durban.

She later become di first woman wey start law practice for Natal Province for 1967, and later di first non-white woman wey dem appoint to di high court for di kontri.

Pillay serve as judge for di UN-backed International Criminal Tribunal for Rwanda - wey focus on di 1994 genocide wey kill 800,000 pipo - including four years as di president.

From 2021-25, she chair di UN Independent International Commission of Inquiry on di Occupied Palestinian Territory - na fact-finding body wey di UN Human Rights Council establish to investigate alleged violation of international law.

Currently, na she be di judge on di International Court of Justice wey dey handle di case wia Myanmar stand accuse of genocide.

Why she win? Di Norwegian Nobel Committee tok she win di award for "her efforts to promote peace and international law" and praise her for showing say legal measures fit help prevent acts of war and violence".

Wetin she tok afta she win di award? Pillay tok say she dey "surprised" and dedicate di award to "all di survivors of international crime".

Foto of Nelson Mandela

Navi Pillay na di fifth South African wey go win di Nobel Peace Prize.

Di past winners for di award from South Africa include di former President Nelson Mandela, wey win for1993 alongside South African FW De Klerk

South Africa get oda winners like di late Archbishop Desmond Tutu, wey win di prize for 1984 for im work against apartheid and for di promotion of human rights.

Di kontri first Peace Prize winner na Albert Luthuli, wey be one of di early leaders of di anti-apartheid African National Congress.

E win di prize for 1961, becoming Africa first Nobel Peace Prize laureate.