Super Eagles 23 players wey dem dey cari go shake Russia

Published

Nigeria don release names of 23 players wey dey go Russia for FIFA World Cup and na here you go sabi all dia faces and wia dem dey play.

Akpeyi
Wetin we call dis foto, Daniel Akpeyi dey play for Chippa United for South Africa. Di goalkeeper dey 32 years.
Francis Uzoho
Wetin we call dis foto, Francis Uzoho na goalkeeper wey dey play for Deportivo de La Coruña for Spain. Im dey 19 years.
Ezenwa
Wetin we call dis foto, Ekene Ezenwa na goalkeeper of Enyimba FC for di Nigeria. Im dey 29 years.
Ekong
Wetin we call dis foto, William Troost-Ekong na central backman wey dey play for Turkish club Bursaspor. Im dey 24 years.
Omeruo
Wetin we call dis foto, Kenneth Omeruo na Chelsea central backman wey dey on loan to Kasımpaşa for Turkey. Dem born am for 1993.
Leon balogun
Wetin we call dis foto, Leon Balogun na central backman wey dey 29 years. Im don sign to play for Brighton for Premier League.
Echijile
Wetin we call dis foto, Elderson Echiejile na left side backman wey dey play for Cercle Brugge K.S.V for Belgium. Im dey 30 years.
Olu
Wetin we call dis foto, Brian Idowu na left side backman wey dey play for FC Amkar Perm for Russia. Im dey 26 years.
Tyronne Ebuehi
Wetin we call dis foto, Tyronne Ebuehi na right side backman wey dey play for Benfica for Portugalna right side backman wey dey play for Benfica for Portugal. Im dey 22 years.
Awaziem
Wetin we call dis foto, Chidozie Awaziem dey play for French club FC Nantes but im dey on loan from FC Porto. Im na central backman. Im dey 21 years.
Shehu Abdullahi
Wetin we call dis foto, Shehu Abdullahi dey play for Turkish side Bursaspor. Im be right side backman and e dey 25 years.
Ndidi
Wetin we call dis foto, Wilfred Ndidi na midfielder wey dey play for Leicester City for English Premier League. Im dey 21 years.
John Ogu
Wetin we call dis foto, John Ogu na central midfielder wey dey play for Hapoel Be'er Sheva for Israel. Im dey 30 years.
Obi
Wetin we call dis foto, Joel Obi dey play for Italian league wit Torino. Im be midfielder wey dey 27 years.
Oghenekaro Etebo
Wetin we call dis foto, Oghenekaro Etebo dey play for Spanish club UD Las Palmas. Di 22 years old na midfielder.
Onazi
Wetin we call dis foto, Ogenyi Onazi na vice captain of di Super Eagles and e dey play for Trabzonspor for Turkey. Im dey 25 years.
Mikel
Wetin we call dis foto, John Mikel Obi na im be di captain of di team. Di midfielder dey 31 years and e dey play for Chinese club Tianjin TEDA.
Iwobi
Wetin we call dis foto, Alex Iwobi of Arsenal na frontman wey dey 22 years.
Iheanacho
Wetin we call dis foto, Kelechi Ihenacho dey play for Leicester City. Di frontman dey 21 years.
Ighalo
Wetin we call dis foto, Odion Ighalo na frontman wey dey play for Changchun Yatai F.C for China. Im dey 28 years.
Moses
Wetin we call dis foto, Victor Moses of Chelsea FC for England na frontman and im dey 27 years.
Musa
Wetin we call dis foto, Ahmed Musa wey get speed well-well, dey play for Russian club CSKA Moscow. Im dey 25 years.
Simeon Nwankwo
Wetin we call dis foto, Simeon Nwankwo dey play for Crotone for Italy. Di frontman dey 26 years and na only once im don play for Nigeria before di world Cup.