Lines for some polling units dey empty but pipo wey don vote dey wait for counting
For some areas, voters no too show face like dat.
BBC News Pidgin tori pesin wey dey cova di election say for polling unit 001 Baptist Day Primary School, Ward 09 Ojo/Aro Egbedore LGA, out of ova 700 registered voters na only 300 pipo don vote so far.
E send dis tori around few minutes past 1pm for afternoon.
Di line dey empty. Plenti pipo neva come out to come vote, while dose wey don vote still hang around to wait for counting of votes.