Burkina Faso and Mali react to di mutiny attack for Niger

Published
Read am in 5 mins

Niger say dem don regain control of one key military airbase for di capital, Niamey, afta revolutionary soldiers attack di site plus oda strategic locations.

Di fighting, wey start early on Saturday, 29 August na di latest challenge to military ruler Abdourahamane Tiani, wey im govment for a long time now dey battle long- and increasingly severe jihadist insurgency.

Niger authorities tok say dem contain di opposition sojas and forces wey dey loyal don restore order.

Di Ministry of Defence explain say some group of soldiers wey break military rules bin detain some of dia colleagues for Base 101 for di early hours of Saturday, 29 August.

Di sojas also open fire for several sensitive locations for di capital, di ministry tok.

Niger state-run television bin describe di attacks for Niamey, as attempted coup, but say di situation dey under control.

Earlier reports say di mutineers bin try to detain military personnel for di base and dem fire gunshots on several sensitive locations for Niamey.

Heavy gunshots and explosions blast across parts of Niger capital, Niamey early mormor on Saturday, according to eyewitnesses. Dem say serious fight happun near Diori Hamani International Airport, di military Base 101 and di presidential palace.

One Niamey resident tell BBC say dem begin hear gunfire and explosions since around 1:00 am.

'Di attack for Niger na betrayal' - AES

Meanwhile, di Confederation of Sahel States (AES) say di attacks wey happun for Niamey, di Niger capital on Saturday na betrayal by some soldiers.

Di AES wey include Bukina Faso, and Niger for statement say di sojas wey dey involved bin warn scata di govment through attacks wey target di Air Base 101 and certain sensitive sites for di city of Niamey, during di night of 28 to 29 August 2026.

"Thanks to di bravery and professionalism of di loyal republican forces, dem contain dis new attempt and stop am," dem add.

AES also say di "Di Confederation of Sahel States (AES) remain fully committed and mobilised alongside Niger, wit which dem shares di determination to continue di struggle for sovereignty and peace."

Dem also reaffirm dia determination to preserve di unity, cohesion, and stability of di confederation.

Di AES call on di pipo of Burkina Faso, Mali and Niger to remain "vigilant against disinformation campaigns, opinion manipulation, and attempts at division wey fit accompany destabilization efforts.

Niger state broadcaster bin show footage of several alleged mutineers wey di Presidential Guard arrest.

Authorities neva release any official casualty figures.

Gen Tiani also neva publicly address di incident. Russia say dia forces also assist Niger during di mutiny.

On Saturday, posts on social media bin show as residents dey react to di sounds of di gunfire wey dem link to di incidents for parts of Niamey.

One security source tell Reuters say di attackers bin target di airport and try to breach di security perimeter around di presidency.

One AES parliament member say security forces don regain control of Air Base 101 and e describe di attackers as "terrorists".

BBC neva independently verify di claim.

Niger military authorities for dia initial reaction, don ask di pipo for di capital, Niamey, to remain calm afta reports of heavy gunfire and explosions for several parts of di city.

Di National Council for di Safeguarding of di Homeland (CNSP) on Saturday morning tok say dem don "mobilise Defence and Security Forces to defend di nation."

Dem also say make kontri pipo "remain united, vigilant and supportive" and urge dem to "remain calm and stop dey share unverified information."

Authorities neva tok who dem believe say dey behind di reported attack. Also, no official details on casualties or damage.

However, reports don point to di Islamic State of Sahel affiliate, but e no dey confirmed.

Di motive for dis attack and di identities of dos wey get hand for inside neva dey clear, also informate neva dey on di full extent of di damages and if casualties dey.

E also neva dey clear if di attack get connection wit attempted coup or insurgent attack.

Niger state broadcaster bin show footage of several alleged mutineers wey di Presidential Guard arrest.

Authorities neva release any official casualty figures.

Gen Tiani also neva publicly address di incident. Russia say dia forces also assist Niger during di mutiny.

Air Base 101, wey be part of di Diori Hamani airport complex, dey host Nigerien military aircraft and drones, plus one AES counter-terrorism unit. Russian and Italian forces also get base for there, according to Reuters.

Niger, Mali and Burkina Faso na military-ruled countries wey don cut ties wit Western partners and strengthen cooperation wit Russia.

But jihadist violence remain widespread for di three countries, despite di shift in alliances.

For Niger govment, Saturday mutiny present an additional problem: di military now dey deal not only wit external insurgency, but signs don show say e get some pipo within di ranks wey no dey happy.

Jihadist don attack di airbase wia di mutiny happu two times dis year - once by one Islamic State affiliate and later by one al-Qaeda affiliate.

Nigerien authorities say security forces don increase patrols around key sites for Niamey, including di main airport entrance, di presidential pavilion and di Squadron.

Niger Press Agency report say commercial activity also dey return to normal, petrol stations, shops and oda businesses dey reopen.

Junta supporters from various backgrounds bin gada for Concertation Square for Niamey in support of di defence and security forces and Gen Tiani govment.

Authorities neva tok weda dem don completely resolve di mutiny or announce how many soldiers dey involved.